歌词
I don sing song for the great African men
I don sing song for the great African men
Na Osagyefo Kwame N'kruma be the greatest one
I don sing song for the great African men
I don sing song against African thieves
I don sing song against African thieves
Na Obasanjo be the biggest thieve I sing about and Abiola
I don sing song against African thieves
Ah many African young people today
Dey no know anything about Kwame N'kruma
To know Nkruma Yeye leaders no fit dey
To know Nkruma Yeye President no fit dey
To know Nkruma Africa quality go show
To know Nkruma Prosperity go dey flow
To know Nkruma African pride go dey shine
To know Nkruma Yeye leaders wey e dey
To know Nkruma Good good things go dey happen
To know Nkruma Good good things go dey happen
To know Nkruma Good good things go dey happen
To know Nkruma Good good things go dey happen
To know Nkruma Good good things go dey happen
When one good man want rise for Africa
Today bad leaders dey go wan finish am o
When one good man want rise for Africa
Today useless people dey go wan finish am o
Dem go plan against am
Lie against am, lie against am
Talk against am, talk against am
Gang against am, gang against am
Plan against am, lie against am
You no see N'kruma dey finish am o
You no see Sekou Toure dey finish am o
You no see Lumumba dey finish am o
You no see Idi Amin dey finish am o
You no see Ben Bella dey finish am o
You no see Mandela as dey want killed am
You no see Beko as dey want killed am
You no see my brother as dey want killed am
Everywhere all over the world
Young people dem go dey look up to leaders
Wetin leaders do young people go dey do
One good thing African people dey do
Few of dem dem go gather together
Dem go start one club
Dem go dey contribute money together
Dem go dey share the money wey dem dey contribute
Once everything is by turn by turn
One good thing about this matter be say it is in the African tradition
For people to trust demselves
Where is Sankara story o jare (yes o)
One Afrikan leaders dey today (yes o)
Him name na President Sankara (yes o)
This is the only leader wey e dey (yes o)
Wey no dey fear to talk the truth (yes o)
Him name na President Sankara (yes o)
Him be only leader wey e dey (yes o)
Him say Africa unity (yes o)
One African Government for All (yes o)
All the other leaders wey dem dey (yes o)
Na only dem pocket wey dem know (yes o)
Underground system in their lifes (yes o)
One African leader dey today (yes o)
All African people dem like the man (yes o)
Him name na President Sankara (yes o)
Where is Sankara story o jare (yes o)
All African people dem like the man (yes o)
Him name na President Sankara (yes o)
West African Governments dem get one club
Dem call the club dem call am ECOWAS CEDEAO in French
When e reach Sankara's turn to be chairman
African leaders dem start to fear
The underground system in their lifes
This one corruption and destruction
Mismanagement of the mind don start
Underground that is always misinstructs
That comot SANKARA from his turn
Nigeria, Ivory Coast and Senegal
Dem come show the colour of their mind
When e reach Sankara's turn to be chairman
African leaders dem start to fear
The underground system in their lifes
Since I dey young for my country o yeye (yeye o)
Those people i don understand Since
The time i don grow up o yeye (yeye o)
To find people to trust e hard o yeye (yeye o)
Na the leaders wey dey Africa o yeye (yeye o)
Dey no dey show good example o yeye (yeye o)
Na the leaders wey dey Africa o yeye (yeye o)
Den go just dey misbehaving o yeye (yeye o)
The condition of my country o yeye (yeye o)
Dey make me crying for my songs o yeye (yeye o)
On top of all these o yeye (yeye o)
Dem go kill SANKARA o yeeye (yeye o)
As I dey write this song for am o yeye o
Dem go kill Sankara o yeye o
Dem go kill Sankara o yeeye (yeye o)
As I dey write this song for am o yeeye (yeye o)
As I dey write this song for am O
When e reach my turn for turn by turn
When my turn by turn for chairman reach
When e reach my turn for turn by turn
When my turn by turn for chairman reach
The chairman na by turn by turn
The money all by turn by turn
The chairman na by turn by turn
All na by turn by turn
The chairman all by turn by turn
The money all by turn by turn
The chairman all by turn by turn
All na by turn by turn
All by turn by turn don turn to mess
If dem kill Sankara nko
Dem shoot him today e no go possible tomorrow
If dem kill Sankara nko
The blood go dey for dem head o
Dem shoot him today e no go possible tomorrow
If dem kill Sankara nko
Den No fit kill hin spirit o
Dem shoot him today e no go possible tomorrow
If dem kill Sankara nko
Den No fit kill hin spirit o
Dem shoot him today e no go possible tomorrow
If dem kill Sankara nko
The blood go dey for dem head o
Dem shoot him today e no go possible tomorrow
专辑信息
1.Underground System - Part 2